24 So Moses listin to en wife papa kon do all di tins wey e tell am.
Den Shekanaya wey bi Jehiel pikin wey kom from Elam family kon tell Ezra, “Wi nor dey faithful to God, bikos wi go marry doz strenj wimen, but even with dat, Israel still get hope.
So Ezra get up kon make di leaders among di priests, Levi pipol and all Israel pipol swear sey dem go do anytin wey Shekanaya tok.
E guide and keep dem as dem dey go; but di sea kill dia enemies.
So, I go advise yu and make God dey with yu. Na yu go stand before God for dis pipol kon take dia matter go meet am.
If yu do dis tin and if na God really kommand yu, den di work go eazy for yu and di pipol go happy go house.”
Moses choose men wey fit do di work among Israel pipol kon make dem oga ova di pipol. Some dey rule tazons, odas hundred, some fifty and some ten.
Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin,
So, di eye nor go fit tell di hand sey, “I nor nid yu” and di head nor go fit tell di leg sey, “I nor nid yu too.”
Moses still sey, “For dat time, I sey, ‘Una wahala too mush for only mi.