But dem ansa. “Yu nor go follow us, bikos e nor go mean anytin to di enemy if wi wey remain turn and run or even if dem kill half of us, but only yu bi like 10,000 of us. E go betta make yu stay here dey send help kom give us.”
But Abishai, Zeruaya son, run kom help David attack di giant kon kill-am. Den David men kon sey make David promise dem sey e nor go follow dem go fight war again. Dem sey, “Na yu bi di hope wey Israel get and wi nor won luz yu.”
Make una know sey na bikos God sey make una rest for Sabat Day naim make am dey give una doubol food for di sixt day. So make evribody stay en house; make nobody komot en house for di sevent day.”
Dem go judge di pipol and any matter wey big pass dem, dem go bring am kom meet yu, but na dem go dey judge all di small-small matter. Like dis, dem go follow yu share for di load.
Wen Paul and Banabas don argue with di pipol well-well, di church pipol kon send Paul and Banabas with some oda pipol go Jerusalem go meet di apostles and di eldas, so dat dem go ask dem about di matter.
I go der bikos of di revelashon wey I receive, den I tell dem about wetin I dey prish give Gentile pipol. But I tok with di oga dem, so dat dem go dey sure sey, I dey prish Christ message.
God tell Samuel, “Go do as dem tok and make yu give dem king wey go rule dem.” Den Samuel tell di men for Israel, “Make all of una dey go back to una house.”