Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 18:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Wen dem get any matter, di pipol go kom and I go judge and let dem know God kommand, en rules and law.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 18:16
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Absalom go tell am, “Si, una dey rite for wetin una dey do, but e nor get anybody wey won ripresent di king make e for listin to una.”


Wen ever una kountry man kon ripot matter give una (weda e koncern pesin wey dem kill or about di law and kommandments), make una warn dem sey make dem nor sin against God. If una nor do like dat, God go vex for una and doz wey dey work with una, but if una obey am, una go dey free.


If any of my savant komplain give mi, I dey listin and I dey trit dem well.


Den Moses wife papa tell am, “Di tins wey yu dey do so good o-o.


Wen e kom outside di next day, e si two Hibru men dey fight. So e kon tell di one wey do bad sey, “Wetin make yu dey beat yor broda like dat.”


“Make una nor akuiz pesin for wetin e nor do and make una nor kill good pesin, bikos I nor go free anybody wey do like dat.


Before Moses go, e tell di eldas sey, “Make una wait for mi for here, until I go kom back. Aaron and Hur dey with una. Anybody wey get matter against anoda pesin, make e go meet dem and dem go setol am.”


Make yu tell Israel pipol sey anybody wey curse God, go sofa di ponishment for en sin


Den God tell Moses, “Di man must die; make di whole kommunity take am go outside di kamp kon stone am till e die.”


dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”


Wen pesin nor dey gri with anoda pesin, una dey take una kase go kourt where sinnas go judge di matter, abi una dey take am go meet God pipol?


Si! I don tish una di rules and law, just as God tell mi, so dat una go dey do dem for di land wey una won enter go stay.


Den Moses koll Israel pipol kon sey: “Make una listin well-well to all di law and rules wey I dey give una today, so dat una go learn and obey dem!


Dis na di kommandment, statutes and ordinances wey Oga God give mi make I tish una and una must obey and do dem for di land where una dey go.


As for mi, God forbid sey I nor go dey pray for una again, bikos dat na sin. I go tell una di tin wey dey good and wey dey make belle sweet God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ