Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 17:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 So Moses tell Joshua, “Make yu go choose some men for us, so dat una go-go fight Amalek pipol. Tumoro, I go stand on-top di hill with God stik for my hand.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 17:9
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Like dis, Joshua win Amalek pipol and dia sojas.


But make yu choose good men from di pipol. Men wey dey fear God; dey tok true; doz wey nor dey play wayo kon make dem rulers ova di pipol. Some fit rule tazons, odas hundred, some fifty, while some go rule ten.


So Moses and Joshua wey dey follow am kon go di mountin, den Moses klimb go meet God.


God go tok to Moses face-to-face, just as man dey tok to en friend. Den Moses go-go back to di kamp; but en yong savant Joshua wey bi Nun son, nor go komot from di tent.


Yu go still karry di stik follow body, bikos naim yu go take do many signs and wonders.”


So God ask Moses, “Wetin dey yor hand?” E ansa, “Na stik.”


Den Moses take en wife and pikin, karry dem put on-top donkey kon go Egypt. Moses hold di stik wey God gi-am for en hand.


Den Joshua wey Nun born, wey dey help Moses since e dey yong kon tell Moses sey, “My oga, make yu stop dem!”


Dis na di men wey Moses send go shek di land. Hoshea wey Nun born, Moses kon shange en name to Joshua.


from Efraim tribe, e send Hoshea (Joshua) wey Nun born;


God ansa, “Make yu take Joshua wey Nun born kon put yor hand for en head, bikos na-im go fit lead dem;


“Afta, awa grand-grand papa dem karry di Tabanako wey God give dem with Joshua kon drive all di oda tribes and take dia land till di time wey David bigin rule Israel.


Den Moses go with Joshua, Nun pikin kon sing all di word for di song give di pipol.


Bikos if to sey Joshua give dem rest, God for nor tok about anoda day.


God kon tell Joshua, “Dis swod wey dey yor hand, make yu point am face Ai, bikos I don gi-am to yu and yor sojas.”


Joshua and all di sojas kon mash dey go Ai town. Joshua choose 30,000 strong sojas kon send dem go for nite.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ