Moses kry to God and God kon show am one stik. Wen e trow am inside di wota, di wota kon dey good to drink. So for der, God give dem laws kon try dia faith.
But afta some Jew pipol wey kom from Antiok and Ikonium don win di pipol mind, dem kon stone Paul, drag am komot from di town, bikos dem tink sey e don die.
David vex well-well, bikos en men dey tink for dia mind sey make dem stone am. Each man dey kry for en pikin. But di Oga God kon give David strong mind.