1 Israel pipol kon start to travel from Sin Wildaness, just as Oga God kommand dem. Dem stay for Refidim, but di pipol nor si wota to drink for der.
Den Moses lead Israel pipol from di Red Sea enter Shur wildaness. Dem travel inside di wildaness for three days and dem nor si wota drink.
Wen Israel pipol komot from Elim, dem kon go Sin Wildaness wey dey between Elim and Sinai for di Fifteent day for di sekond mont afta dem don komot from Egypt.
Amalek pipol kon attack Israel pipol for Refidim.
Afta dem travel komot from Refidim, dem rish Sinai Wildaness kon stay for di mountin front.
Wota nor dey, so di pipol kon gada round Moses and Aaron
Wen ever di kloud komot from di Tabanako, Israel pipol go kontinue dia journey and anywhere wey di kloud for kom down, Israel pipol go kamp for der.
Just as God kommand, dem go stay for one place or travel, bikos dem dey obey di words wey God kommand Moses.