For morning, una go si God glory, bikos E don hear as una dey komplain against am. Na-im una dey komplain to, nor bi wi wey just bi ordinary human being.”
So Moses sey, “Wen God give una meat chop for evening and bread for morning, den una go know sey, E don hear all una komplain. Wetin wi bi sef? Una komplain nor bi against us, but na against God.”