Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 16:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Den Oga God tell Moses, “I go give una bread from heaven and di pipol go dey gada di ones wey go rish dem chop evriday, so dat I go fit test and know if dem go follow my kommandment.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 16:4
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem dey do evritin as e suppose bi evriday, just as dem rite am for di royal kommand wey dem dey follow.


Wen dem dey hongry, Yu give dem bread from heaven and wen dem won drink wota, Yu give dem wota from rock. Yu tell dem sey make dem kontrol di land wey Yu promise to give dem.


Yu send yor good Spirit make e tell dem wetin dem go do and Yu nor stop to give dem manna chop and wota to drink.


Dem ask for meat and God give dem kwail bird; E give dem manna wey bi bread from heaven, so dat dem go chop beleful.


But E kommand di sky make e open, den E open di doors for heaven.


Moses kry to God and God kon show am one stik. Wen e trow am inside di wota, di wota kon dey good to drink. So for der, God give dem laws kon try dia faith.


Wen Israel pipol si am, dem bigin ask each oda, “Wetin bi dis?” Bikos dem nor know wetin e bi. Den Moses tell dem, “Na di bread wey God send kom give una.


Di first one na: Help mi make I nor dey lie and deceive pipol and di sekond one na, make Yu nor make mi too rish or too poor! Make yu give mi di tins wey go rish mi use.


feed una for di wildaness with manna (food wey una grand-grand papa nor ever know), so dat E go honbol and test una, den make una betta pipol.


Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not.


If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ