Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 16:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 So Israel pipol chop manna for forty years until dem rish Kanaan land.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 16:35
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen dem dey hongry, Yu give dem bread from heaven and wen dem won drink wota, Yu give dem wota from rock. Yu tell dem sey make dem kontrol di land wey Yu promise to give dem.


So God vex for Israel pipol kon make dem waka anyhow for di wildaness for forty years, until all di pipol wey do bad before God, die finish.


Aaron di priest klimb Mount Hor akordin to God kommand and e die for der for di nomba forty years wey Israel pipol komot from Egypt land for di first day for di fift mont.


Na dis Moses lead dem komot from Egypt. E still do plenty mirakles for Egypt, di Red Sea and inside di wildaness for forty years.


Look! I don already give di land to una. So make una go kollect di land wey mi God promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak, Jakob and dia shidren.”


“ ‘Di Oga wey bi una God don bless una for evritin wey una dey do. Evry step wey una take for di great wildaness, I dey with una. For dis forty years wey una dey dis wildaness, God dey with una and una get evritin.’ ”


But till today, God neva make una undastand all dis tins or give una eyes wey fit si or ear wey dey hear!


For dis forty years, una klot nor even tear and una leg nor get sore at-all.


From di day wey dem chop di food wey grow for di land, manna kon stop to fall. So, Israel pipol nor chop manna again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ