Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 16:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 Just as God kommand Moses, Aaron kon put am for di Kovenant Box front, so dat e go dey save.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 16:34
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na only di stone tablets wey God take make Kovenant with Israel pipol as dem dey kom from Egypt, dey inside di Kovenant Box and na Moses put am wen dem dey Mount Sinai.


Di two small flat stones wey I go rite my kommandment put, yu go put dem inside di box.


Yu go put di box kover on-top di box, den kon put di flat stones wey I go give yu, inside.


Aaron and en sons go dey arrange di lamps from morning till evening before di Oga dia God. Dis kommandment na for Israel pipol and dia pikin dem and e go dey forever.”


Yu go grind some to powder, den put some for di Testimony Box wey dey inside di tent where dem for dey do meetin; di place where I go for meet yu. Na-im must dey holy pass to yu.


Den make yu put di incense altar for di front of di curtain wey dey di Testimony Box front (before di sakrifice place wey dey on-top di Testimony Box), where I go for meet yu.


Wen God don tok to Moses finish for Mount Sinai, E kon gi-am two stones wey E rite di kommandment put.


Dis na di materials wey dem use take build di Tabanako, just as Moses tok. Na Levi pipol do di work and Itama wey bi Aaron pikin, na-im dey show dem wetin dem go do.


E take di testimony stones kon put am inside di box, tie di poles for di box, den put di kover on-top.


But make yu put Levi pipol to look, kare and dey near di Tabanako and evritin wey dey inside.


But Levi pipol go kamp near di Tabanako to guide am, so dat nobody go-go near am kon make God strike Israel pipol.”


Den God tell Moses, “Make yu bring Aaron stik kom back before di Testimony Box kon keep am as sign for sturbon pipol, so dat dia komplain go stop and dem nor go die.”


Den I kom down from di mountin kon put di two stones for di box wey I make, just as God kommand mi and di stones still dey der.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ