Wen Israel pipol si am, dem bigin ask each oda, “Wetin bi dis?” Bikos dem nor know wetin e bi. Den Moses tell dem, “Na di bread wey God send kom give una.
Den Moses sey, “Dis na wetin God kommand: ‘Make una keep one full omer wey go dey from one generashon go rish anoda, so dat dem go si di food wey I dey give una for di wildaness, afta I take una komot from Egypt.’ ”
Just as apple tree dey among oda trees for forest, na so my love bi among di yong men. I dey like sidan for where e dey and en fruit dey sweet mi to chop.
True-true! E make una dey honbol thru honga kon dey give una food wey una nor know (manna) make una chop. E do dis to tish una sey human being nor nid only food, but dem still dey alive bikos of wetin God tok.