But some nor gri listin to Moses, bikos dem still keep some till di next day. Di food wey dem keep kon get worm and e start to smell, so Moses kon dey vex for doz pipol.
Moses kon tell Aaron, “Make yu measure one omer for manna with one kontaina, den put am for where Oga God Spirit dey, so dat E go take am dey remember di generashon wey dey kom for back.”