22 For di sixt day, dem gada doubol food, two omer for one pesin. Den di leaders for di kommunity kom ask Moses, “Why e bi like dat.”
Dis na wetin God kommand: ‘Make evribody take wetin e fit chop. One omer for one pesin; den una go gada akordin to di pipol wey dey una house.’ ”
So Israel pipol kon dey gada am evry morning; each pesin akordin to wetin e fit chop finish and wen sun don make evriwhere hot, di rest food go melt.
But for di sixt day, make dem gada doubol of wetin dem bin dey gada.”
But Moses koll dem kom meet am, so Aaron and all di leaders waka go meet am. Den Moses tok to dem.
Di whole year go dey holy to una; una go chop only di food wey di land produce by ensef.
Even wen una plant for una farm for di eight year, una go still dey chop wetin una harvest for di sixt year and una go get plenty food to chop. Even wen una harvest for di ninet year, di ones wey una harvest for di sixt year, go still remain.