18 Wen dem measure with one omer, di pesin wey gada plenty nor get pass who gada small: evribody gada wetin e go fit chop finish.
So Israel pipol do as God kommand. Some gada plenty, while odas gada small.
Dis towns must bi Israel pipol own. Di tribes wey big go give more land to Levi pipol, while di small tribes go give small land to Levi pipol. Each tribe go give Levi pipol akordin to di propaty wey dem get.”