17 So Israel pipol do as God kommand. Some gada plenty, while odas gada small.
Dis na wetin God kommand: ‘Make evribody take wetin e fit chop. One omer for one pesin; den una go gada akordin to di pipol wey dey una house.’ ”
Wen dem measure with one omer, di pesin wey gada plenty nor get pass who gada small: evribody gada wetin e go fit chop finish.