Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 15:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Betta fear go katch dem and with yor great pawa, dem go bi like stone kon dey fear until di pipol wey Yu save, go waka pass.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 15:16
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

and dem kon start dia journey. Di towns wey dey dat aria dey fear God and fear nor gri let dem porshu Jakob and en shidren.


No kountry for dis world bi like Israel wey Yu komot from slave kon make dem yor pipol. Di big tins wey Yu do for dem, make pipol know yor name for di whole world. Yu save yor pipol from Egypt, plus di juju and gods wey dey der.


Egypt pipol happy wen Israel pipol dey komot from dia land, bikos dem dey fear Israel pipol well-well.


Make Yu remember sey na wi bi di pipol wey Yu choose since Yu kreate di world; di tribe wey Yu take as yor own! Make Yu still remember Jerusalem where Yu dey stay.


Na raitiousness and justice Yu take make di foundashon for yor throne. Yu dey rule with trut and love wey nor dey fail.


But for Israel pipol side, peace go dey well-well, even dog nor go bark for anybody or animal, den yu go know sey Oga God don separate Israel pipol from Egypt pipol.


With yor true love, Yu go lead di pipol wey Yu save and with yor pawa, Yu go show dem di way to yor holy land.


Di deep sea kover dem; dem sink go bottom like stone.


My Oga God, yor rite hand get betta pawa and e skata di enemies to pieces.


Moses tell en wife papa evritin wey God do to Fero and Egypt pipol, bikos of Israel pipol; di tins wey dem sofa for road and how God take save dem.


“Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, where una for bi slave.


“I go send one angel wey go protet una for front as una dey go and e go bring una kom di place wey I don prepare for una.


But if una obey am kon do all di tins wey I tell una, den I go bi enemy to doz wey bi una enemies and I go fight doz wey dey fight against una.


“I go put my fear for inside doz wey una go fight kon distroy dem; I go make all una enemies run from una.


I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una.


Na Yu dry di sea kon make road for inside wota, so dat di pipol wey Yu won save, go fit waka pass for dry groun.


Where God wey do great tins thru Moses wey divide di sea kon lead en pipol pass di deep wota, so dat honor and glory wey nor dey end, go bi en own?”


God go free and save Israel pipol from strong nashons wey dey opress dem.


“ ‘ “As I dey waka pass again, I kon si sey di time wey yu suppose to undastand wetin love mean, don rish. So, I kover yor naked body with my klot kon promise sey I go always love yu. Yes, I marry yu and yu kon bi my own.” ’ ” Dis na wetin God wey get pawa dey tok.


Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.


Nobody go fit stop una; di Oga una God go make dem fear una for any land wey una waka enter, just as E promise una.


From today, evribody wey dey di world, I go put fear for dia mind, bikos of una and even wen dem hear una name, fear go katch dem. Dem go fear nearly die wen dem hear sey una dey kom.”


Make yu give dis kommand to di pipol: ‘Una go soon cross una pipol Edom kountry, wey una broda Esau bi dia grand-grand papa and dem dey stay for Seir. Edom pipol go dey fear una so make una dey kareful.


Dis pipol wey nor get sense at-all, na like dis una won take pay God? Nor bi en bi una papa wey kreate una? Na-im kreate and make una strong.


Na God get di pipol for Israel; na Jakob bi en special propaty.


E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.


kon tell dem, “I know sey God go give una dis town. Wi dey fear una well-well and evribody wey dey stay di town dey shake bikos of una.


E do am make all di kountry for eart know sey na God get all di pawa, so una must always obey di Oga wey bi una God.”


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.


E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.


Wen day break wen Nabal eye neva klear well-well, en wife kon tell am wetin happen. Na wons e get stroke and e nor fit waka again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ