Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!
God go divide Egypt pipol sea; E go wave en hand pass Eufrates River kon send one strong breeze, den E go turn am to seven small river wey don dry kon make pipol dey waka pass with ordinary leg.
Wen E kommand, en vois dey sound like tonda and di wota for heaven go make nois like lion vois. E dey make kloud kom out from where di eart for end. E dey bring tonda lite wen rain dey fall and E dey make breeze blow kom from where E keep dem put.
“Na mi God kreate di mountins and breeze. I allow human being know wetin I dey tink. Na mi dey bring darkness to take kover lite and I dey waka on-top di hill. Na mi bi God and na mi get all di pawa.”
Dem nor si wetin God do to Egypt sojas and dia shariot. How E take kill dem for di Red Sea wen dem dey porshu una. E distroy dem finish and dem neva fit balance kon rish today!