God go divide Egypt pipol sea; E go wave en hand pass Eufrates River kon send one strong breeze, den E go turn am to seven small river wey don dry kon make pipol dey waka pass with ordinary leg.
Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.
Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.
di wota wey dey rush, just stop. E gada go up for one town wey dem dey koll Adam (Adam dey near Zaretan) and no wota rush kom from der again go rish Arabah Sea (Di Salt Sea). Di pipol cross di river wey face Jeriko.