All dis tins dey happen, so dat yu go fit tell yor shidren and grand-shidren how I take fool Egypt pipol with my mirakles, make dem for know sey na mi bi God.”
E make dia shariot taya sink and dem nor fit ride fast, den Egypt sojas kon sey, “Make wi run go back from dis pipol, na God dey fight us bikos of dem.”
I go make Fero heart strong again and e go porshu una and una go honor mi, bikos of wetin I go do Fero and en sojas, den Egypt pipol go know sey na mi bi Oga God.” So Israel pipol do as Moses tell dem.
I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una.
God sey, ‘Naw, wetin I go do, go make yu know sey na mi bi Oga God.’ Si, I go nak di wota for River Nile with di stik wey dey my hand and e go shange to blood.
Tell di pipol for der wetin mi God wey get pawa dey tell dem: “Sidon pipol, I bi una enemy and pipol go praiz mi, bikos of wetin I go do una. Dem go know sey na mi bi God wen I don show as I holy rish and afta I ponish evribody wey dey stay Sidon.
Yu and yor pipol go attack my pipol like strong kloud wey dey pass di land. Wen di time don rish, I go send yu go skata my land, so dat dem go know who I bi and dem go si as I holy rish, bikos of di tins wey I go do thru yu.