Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 14:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 God go fight for una, so make una nor worry.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 14:14
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jahaziel kon sey, “Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem with Jehoshafat, make una listin! Dis na wetin God dey tok, ‘Make una nor fear, bikos of dis plenty sojas! Bikos di fight nor bi una own, but na God go fight am.’


Una nor go fight for dis war. Make una just stand kon si how God go diliver una wey bi Judah and Jerusalem pipol. Make una nor fear, make una go fight dem tumoro, bikos God dey with una.”


All di oda kingdom wey near dem kon dey fear God wen dem hear as E fight Israel pipol enemies.


I si sey di pipol dey worry, so I kon tell dem, dia ofisas and dia leaders sey, “Make una nor fear awa enemies. Make una remember how great and mighty God bi, den make una fight for una brodas, shidren, wifes and una house.”


So if una hear di trumpet nois, make una gada round mi and awa God go fight for us.”


Yu divide di sea for yor pipol kon lead dem pass for dry groun. But Yu make di wota swallow di pipol wey dey porshu dem and dem kon sink like stone.


My God, make Yu oppoz doz wey dey oppoz mi and fight doz wey dey fight mi.


Awa God dey kom and E nor dey kwayet at-all. Fire dey burn evritin wey dey en way and strong breeze wey dey make nois, dey round am.


My God, make Yu nor kwayet just like dat! Make Yu nor rijet us! Nor just do like sey e nor koncern Yu!


Den Oga God tell Moses, “Wetin make yu dey kry to mi? Tell di pipol make dem move go front.


E make dia shariot taya sink and dem nor fit ride fast, den Egypt sojas kon sey, “Make wi run go back from dis pipol, na God dey fight us bikos of dem.”


Awa Oga sabi fight war, na God bi en name.


Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: “I wish sey una gri turn from sin kom meet mi kon dey wait with patient, I for diliver una; if una kwayet, dey wait mi, I go give una strent and pawa, but una nor gri wait.


So e betta make wi sidan kwayet kon wait until God go kom save us.


Di Oga una God go first go fight for una, just as una si evritin wey E do for Egypt


Bikos di Oga una God dey go with una! E go fight una enemies for una kon make una win di war!”


So make una nor fear, bikos di Oga una God go fight for una by ensef.”


God make dem fear as dem si Israel pipol. Israel pipol really kill dem for Gibeon der. Israel pipol porshu dem pass Bet-Horon kon dey kill dem until dem rish Azeka and Makkedah.


Dat kind tin neva happen before and e nor happen again. God listin to one man, bikos E fight for en pipol, Israel!


Joshua katch all dis kings and dia land for just one fight, bikos di Oga wey bi Israel God dey fight for en pipol.


Only one of una fit make 1,000 pipol run, bikos di Oga una God dey fight for una as E promise.


Una si evritin wey di Oga una God do to di oda nashons and as E take fight for una.


From di sky, di stars dey move and fight against Sisera.


Fear katch Filistia pipol, bikos dem fill sey difren gods don enter Israel kamp. Dem kon sey, “Dis one bad for us! Wi neva si anytin like dis before o-o!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ