Wen Fero free di pipol, God nor take dem pass Filistia pipol land even doh, na dat side near pass, bikos God sey, “Make di pipol nor go shange dia mind wen dem si war kon sey, ‘Wi won go back to Egypt.’ ”
Moses kry to God and God kon show am one stik. Wen e trow am inside di wota, di wota kon dey good to drink. So for der, God give dem laws kon try dia faith.
So some pipol kon tell Judah king sey Siria sojas dey for Israel aria, den en and all en pipol kon dey fear, sotey dem bigin shake like tree wey breeze dey blow.
Make una remember and nor ever forget how una make di Oga una God vex for di wildaness. From di day wey una komot Egypt kon rish naw, una dey always sin against God.
Una papa kry to God make E help dem; den di aria between una papa and Egypt sojas, God make am dark kon kill all Egypt sojas inside di sea. Wetin E do for Egypt, una si am with una own eye. Una stay tey for di desert.
Dis kind love nor get fear, bikos betta love dey drive fear komot from pesin heart. If wi dey fear bikos wi nor wont make God ponish us, dat show sey wi neva really know how en love bi.