Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 13:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Afta God don take una enter Kanaan, Hit, Amor, Hiv and Jebus pipol land; di place wey E promise una grand-grand papa sey E go give dem, land wey good well-well, den una go dey celebrate dis feast for di first mont for evry year.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 13:5
31 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Stay for dis land. Den I go dey with yu kon bless yu, bikos I go give all dis land to yu and yor shidren-shidren. I go do wetin I promise yor papa Abraham.


Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.”


“Una and una shidren must kontinue to obey dis law forever.


Una must celebrate dis feast for di rite time for di year.


“Wen di Oga una God don take una enter Kanaan pipol land as E promise una and una grand-grand papa,


I don promise sey na from Egypt where una dey sofa naw, I go for take karry una go take-ova Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol land, di place where milk and honey full.” ’


I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.


Make Yu remember Abraham, Isaak and Israel yor savants wey Yu promise sey, ‘I go make una shidren-shidren plenty like di stars for sky and all dis land wey I don tok about, I go give dem to una shidren-shidren and dem go stay der forever.’ ”


God tell Moses, “Make yu and di pipol wey yu take komot from Egypt go di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob sey, ‘I go give una shidren-shidren.’


Make yu obey wetin I dey kommand yu today. I go drive Amor, Kanaan, Hit, Periz, Hiv and Jebus pipol komot for una.


I still make kovenant with dem kon promise sey, ‘I go give dem Kanaan pipol land, where dem stay as strenja.’


I go take and give una di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob. Na mi bi Oga God!’ ”


Den I go keep di promise wey I make with dia grand-grand papa kon give dem betta land. And na di land una dey today so.’ ” Den I sey, “Amen! My Oga God, make e bi as Yu tok!”


Yu give dem di rish and betta land wey Yu promise dia grand-grand papa.


Dat time, I promise sey I go take dem komot from Egypt go di land wey I don choose for dem. Di land wey dey okay, good and e fine well-well.


So I tell una: una go stay di land and mi mysef go gi-am to una as una own; bikos milk and honey full am. Na mi bi di Oga una God and I don separate una from di odas.


Nor bi mi kreate or born dem o-o! Why Yu go tell mi sey make I kare and karry dem for my hand like sey dem bi small pikin? Na so I go take karry dem go rish di land wey Yu promise dia grand-grand papa?


Dem tell Moses, “Wi go di land wey yu send us. True-true, milk and honey full der and dis na di fruit wey dey der.


‘Na bikos Yu nor fit take yor pipol go di land wey Yu promise dem, naim make Yu kill dem for di wildaness.’


I promise sey I go give Israel pipol di land, but una nor go enter der, apart from Kaleb and Joshua.


‘Bikos dem nor follow mi with all dia heart, no one among dem from twenty years go wey komot from Egypt go si di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob,


Wen di Oga una God dey go for una front go distroy all di kountries and una drive dem komot kon stay di land,


Wen di Oga una God don distroy di pipol wey E won give dia land to una, una go take di land kon stay for dia towns and house.


Wen una enter di land wey di Oga una God won give una as una own and una don win evribody for der,


Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.)


“ ‘Una cross Jordan River kon rish Jeriko. Di leaders for Jeriko, plus Amor, Periz, Kanaan, Hit, Girgash, Hiv and Jebus pipol kon fight una, but I make una win all of dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ