For di mont wey dem dey koll Abib, una go celebrate di bread wey nor get yist feast and for seven days, una go dey chop bread wey nor get yist, just as I kommand una wen una komot from Egypt. Nobody go kom meet mi with empty hand.
“Una must always dey do di bread wey nor get yist feast. Una must chop bread wey nor get yist for seven days, just as I kommand and e go bi for Abib mont, bikos na for dat mont, una take komot from Egypt.