Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 13:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Naw, God dey lead dem with kloud for day time, den for nite, E dey lead dem with fire, so dat dem go fit travel both for day and nite.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 13:21
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu lead yor pipol with kloud for day time and fire wey go dey give dem lite for nite.


Yet Yu nor still leave dem for inside desert, bikos yor mesi, dey great. Yu nor remove di kloud and fire wey dey show dem lite, both for day and nite.


God kover Israel pipol with kloud kon give dem big fire as lite for nite.


So, my God, wen Yu lead yor pipol go war; wen Yu mash pass di desert,


Den Yu use Moses and Aaron take lead and guide yor pipol like many sheep.


E dey lead dem with kloud for day and pila wey get fire for nite.


E tok to dem from di kloud wey kom as pila and dem obey en kommand and laws wey E give dem.


Den Fero tell dem, “I swear with God sey, I nor go let una take una wimen and shidren follow body! E klear sey yu really get wiked plan!


As Aaron dey tok to Israel pipol, dem turn look di wildaness kon si God glory wey appear inside di kloud.


Wen di pipol si sey Moses nor dey kom down from di mountin, dem gada round Aaron kon tell am, “Make yu make one god for us wey go lead us, bikos wi nor know wetin don happen to Moses wey take us komot from Egypt!”


Who dey waka kom from di desert like smoke or like incense and myrrh? Na fine incense wey dem dey sell?


As dem dey travel, God kloud dey kover dem.


Naw, if Yu distroy dem, wetin yu wont make Egypt pipol tell di pipol for dis land, wey don already bilive sey Yu dey among yor pipol? My God, dem know sey Yu don appear to yor pipol face-to-face. Yor kloud dey kover dem for day time and for nite, yor fire dey with dem.


di Pesin wey dey always go find betta place for una, even before una rish der. E dey appear to una thru fire for nite and inside kloud for day time, so dat E go show una di way wey una go-go.


God go-go for yor front. E go dey with yu; E nor go leave or forget yu. Make fear nor katch yu and make di work nor taya yu.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ