19 Moses pak Josef bones, bikos Josef don make Israel pipol swear wen e sey, “God go kom save una and una must karry my bones komot from dis place.”
Den Israel tell Josef, “Na die I dey so, but God go dey with yu and e go take yu go back to yor papa land.
so di pipol bilive Moses. Wen dem hear sey God don kom save Israel pipol and E don si as dem dey sofa rish, dem kon bow woship am.
En neighbour and rilashons hear sey God don do big tin for am, so dem kom happy with am.
Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!”
So Jakob and awa grand-grand papa dem go Egypt and dem die for der.
Dia bone dey der till dem karry dem go beri for Shekem for di grave wey Abraham buy from Hamor shidren.
Wen Josef life don dey end, na faith e take tok about di long travel wey Israel pipol go-go and e tell dem wetin dem go do with en bones.
Josef bone wey dem karry kom from Egypt, Israel pipol kon beri am for Shekem, for part of di field wey Jakob buy from Hamor sons (Na Hamor bi Shekem papa) and Jakob buy di field for one hundred silva koin.