Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 13:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Dis matter go bi like sign for una hand and fore head, so dat una go remember as di Oga God take karry us komot from Egypt with en mighty pawa.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 13:16
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My God, dis pipol na yor savants and pipol. Na Yu save dem with yor great pawa.


Den E karry Israel pipol komot from der, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.


Di blood go bi sign sey na una dey dat house, so dat wen I si di blood, I go waka pass and I nor go tosh una wen I dey ponish Egypt pipol.


Israel pipol komot for Egypt for di day wey di four hundred and thirty years komplete.


“Wen una son ask una for future sey, ‘Wetin dis tin mean?’ Una go ansa, ‘Na with mighty pawa God take komot us from Egypt where wi for bi slaves.


Dis go bi like sign wey una put for una hand and fore head, so dat Oga God law go dey una mout, bikos na with en strong hand E take karry una komot Egypt.


Den Oga God tell Moses, “Naw, yu go si wetin I go do Fero. I go force am make e allow my pipol go. I go use my pawa take make am drive my pipol komot from dis land.”


“So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol.


Always keep and lock dia words for yor heart! Tie dem round yor neck too.


“Naw, awa God, na Yu take yor pipol komot from Egypt with yor mighty pawa kon make name for yorsef wey dem nor fit forget forever. Wi don sin and wi dey bihave like wiked pipol.


“All wetin dem dey do, na make pipol for si dem. Dem dey tie tins wey dem rite God word put for dia fore head and hand, so dat pipol go si dem.


Na from Israel pipol God choose awa grand-grand papa dem and E kon make dem great for di time wey dem dey Egypt as strenja and E karry dem komot from Egypt with en own hand.


So make una keep dis kommand for una mind. Make una tie dem for una hand kon wear dem for una head, so dat una go remember dem.


So God take us komot from Egypt with en pawa, en strong hand and all en pawaful signs and wonders.


Remember sey una bi savant for Egypt and na di Oga una God take una komot der with en strong pawa. Na dis make God sey make una dey keep di Sabat Day.


Den una go tell dem, “Wi bin dey Egypt as Fero slaves, but God take us komot from Egypt with en own strong hand.


Dem forget di Oga wey bi dia grand-grand papa God wey bring dem kom out from Egypt kon bigin follow and woship di pipol wey dey around dem, gods.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ