Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 13:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 “Wen una son ask una for future sey, ‘Wetin dis tin mean?’ Una go ansa, ‘Na with mighty pawa God take komot us from Egypt where wi for bi slaves.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 13:14
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den my good go tok for mi leta, wen yu go si sey na only di ones wey yu give mi I take. If yu si any animal wey nor get mark, or spot or black, den make yu koll mi tif.”


Make una remember all di mirakles wey E do, en wonderful works and di way E take dey judge,


My God, dis pipol na yor savants and pipol. Na Yu save dem with yor great pawa.


Den E karry Israel pipol komot from der, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.


Make evribody tell dia shidren-shidren about God mighty pawa; make dem tok about evritin wey Yu don do.


Wi nor go hide dis trut from awa shidren; wi go tell di next generashon about di good-good tins wey God do, en pawa and di wonderful tins wey dey sopraiz us.


All dis tins dey happen, so dat yu go fit tell yor shidren and grand-shidren how I take fool Egypt pipol with my mirakles, make dem for know sey na mi bi God.”


Israel pipol komot for Egypt for di day wey di four hundred and thirty years komplete.


So Moses tell di pipol, “Make una remember today wey una komot from Egypt where una for bi slave. Dis na di day wey di Oga una God take una komot with en great pawa. So make nobody chop bread wey get yist.


“Make una tell una shidren for dat day sey, ‘All dis tins wey wi dey do so, na bikos of wetin awa God do for us wen wi komot from Egypt.’


Dis go bi like sign wey una put for una hand and fore head, so dat Oga God law go dey una mout, bikos na with en strong hand E take karry una komot Egypt.


“Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, where una for bi slave.


Den Oga God tell Moses, “Naw, yu go si wetin I go do Fero. I go force am make e allow my pipol go. I go use my pawa take make am drive my pipol komot from dis land.”


“So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol.


I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una.


Israel God tell mi sey make I tell di pipol: “I make kovenant with una grand-grand papa wen I take dem komot from Egypt kon free dem from dia sofa. I tell dem sey,


“Naw, awa God, na Yu take yor pipol komot from Egypt with yor mighty pawa kon make name for yorsef wey dem nor fit forget forever. Wi don sin and wi dey bihave like wiked pipol.


Na from Israel pipol God choose awa grand-grand papa dem and E kon make dem great for di time wey dem dey Egypt as strenja and E karry dem komot from Egypt with en own hand.


Remember sey una bi savant for Egypt and na di Oga una God take una komot der with en strong pawa. Na dis make God sey make una dey keep di Sabat Day.


God sey, “Na mi bi di Oga wey bi una God, di One wey take una komot from Egypt where una for bi slave.


so make una dey kareful, so dat una nor go forget God wey take una komot Egypt.


“Wi swear sey wetin make us do like dis na, bikos wi dey fear sey tumoro una shidren-shidren fit dey ask awa shidren-shidren sey, ‘Who give una di rite to woship di Oga wey bi Israel God?


Bikos na di Oga awa God take wi and awa papa dem komot from sofa for Egypt kon do all doz mirakles for awa front. E still protet us wen wi dey travel pass difren kountries.


Di stones go make una dey remember dis tin wey happen and wen una shidren-shidren ask sey, ‘Wetin make dis stones dey important to una?’


Dem forget di Oga wey bi dia grand-grand papa God wey bring dem kom out from Egypt kon bigin follow and woship di pipol wey dey around dem, gods.


So God send one profet go meet dem with dis message: “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: ‘I take una komot Egypt for where una for bi slave.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ