Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.”
Afta 408 years wen Israel pipol don komot from Egypt, wey bi di fourt year wen Solomon don dey rule Israel, for di sekond mont wey bi Ziv mont, Solomon kon start to build di temple.
Wen Israel pipol komot from Elim, dem kon go Sin Wildaness wey dey between Elim and Sinai for di Fifteent day for di sekond mont afta dem don komot from Egypt.
I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.
“So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol.
Fero nor go gri listin to una. So I go ponish Egypt pipol. I go use force take karry my pipol Israel komot from Egypt land, den judge Egypt pipol well-well.
Na from Israel pipol God choose awa grand-grand papa dem and E kon make dem great for di time wey dem dey Egypt as strenja and E karry dem komot from Egypt with en own hand.
Just to honor di Oga una God, make una dey celebrate di Passova evry year for Abib mont, bikos dat na di mont wey di Oga una God take karry una komot from Egypt for nite.
Bikos E love una grand-grand papa, E kon choose to bless dia shidren-shidren and na en own hand E take komot una from Egypt with all di wonders wey E do.