Yist must nor dey una house for seven days and anybody wey chop anytin wey get yist, nor go dey among Israel kommunity again. Weda na strenja or Israel pesin wey dem born for di land.
Mi wey bi God wey get pawa, dey kommand una sey, strenjas wey neva sekonsaiz; doz wey nor dey obey mi, make dem nor ever enter my temple, even if na strenjas wey dey stay with my pipol.”
Di strenjas wey dey among una and di ones wey born dia shidren for here, go still kollect dia own share wen una dey divide di land. Una go trit dem as una dey trit Israel pipol and dem go trow dice for each land wey go bi any tribe for Israel own.
Make una trit dem as una go trit una fellow Israel pesin. And make una love dem as una love unasef. Make una remember sey, una bi strenja for Egypt before. Na mi bi di Oga una God.
“ ‘If strenja wey dey with una won keep di Passova, dem must do am akordin to all di rules and law. Na di same law di strenja and una own pipol go obey.’ ”
For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.