46 Evribody must chop am inside di house where dem for prepare am and make dem nor karry am from one house go anoda. Make una nor break any of di animals bone.
God dey protet en pipol well-well and E nor go let any bad tin happen to dem,
but wiked pipol go must face wahala and God go ponish doz wey hate en pipol.
Dem must nor leave any food till morning, or break any part for en bone; dem must do am akordin to di Passova law.
But wen dem rish di cross wey Jesus dey and si sey e don die, dem nor kon break en leg.
All dis tin happen to show sey, wetin dem rite for God word na true sey, “Dem nor go break one singol bone for en body.”
Christ body get difren part like evry oda body.