Many pipol wey kom from Efraim, Manasseh, Issakar and Zebulun nor dey klean, but dem still disobey kon chop di Passova food as di law tok. King Hezekaya kon pray for dem sey, “Make Oga God wey dey good, forgive
“ ‘Na like dis una go take chop am: make una dress like who dey travel; wear una shoe kon hold una stik for hand. Make una rush chop am, bikos dis na Oga God Passova.
Dem don dirty my temple, bikos dem dey allow pipol wey neva sekonsaiz enter. Pipol wey nor dey obey mi dey enter di temple wen dem dey offa animal give mi as sakrifice. So my pipol don break di kovenant with all dis yeye tins wey dem dey do.
“ ‘Na only pesin wey kom from di priest family go chop from di holy ofrin; nobody go fit chop dem! Pipol wey dey stay with am or anybody wey e hire to work for am nor go follow am chop.
but if di priest girl pikin husband don die or e don leave en husband and e nor born any pikin kon go back to en papa house, den e fit chop from e papa food, but no strenja go chop am.
“ ‘If strenja wey dey with una won keep di Passova, dem must do am akordin to all di rules and law. Na di same law di strenja and una own pipol go obey.’ ”
Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol.