Dem bake bread wey nor get yist with di bakin pan wey dem dey karry komot Egypt. Di bread nor get yist, bikos dem hurry dem komot from Egypt, so dem nor get time to prepare food for demsef.
Frog go full River Nile and dem go still dey inside una house, bedroom, on-top una bed, inside una savants and una pipol house; una pots and di kontaina wey una take dey fetch wota.
Jesus still tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like yist wey one woman take bake bread. E mix am with plenty flower and di small yist kon make di bread raiz well-well.”