30 Fero with all en savants and evribody for Egypt wake-up for nite bigin kry well-well, bikos e nor get any house where pesin nor for die.
E turn en vexnashon face dem. E nor sorry for Egypt pipol life, but E use strong wahala take distroy dem.
Den Fero tell dem, “I swear with God sey, I nor go let una take una wimen and shidren follow body! E klear sey yu really get wiked plan!
Strong kry go dey evriwhere for Egypt; pipol neva kry like dat before and dem nor go ever kry like dat again.
If yu nor gri listin to poor pipol kry, dem nor go hear yor own kry for help.
Na so-so kry pipol go dey kry for evry vineyards. All dis go happen, bikos I dey kom ponish una.” God wey get pawa don tok.
E send diziz go for en front kon kommand deat follow am for back.
“For mid-nite, somebody kon shaut, ‘Make una wake-up, di man wey won marry, dey kom o-o! Make una kom meet am.’
Judgement nor get mesi for anybody wey nor dey mesi for odas, bikos mesi betta pass judgement.
Doz wey nor die, get sore full body and di kry wey di town pipol dey kry, dey even rish heaven.