24 “Una and una shidren must kontinue to obey dis law forever.
Una go dey remember dis day and celebrate am to di Oga una God forever.
“ ‘So make una kontinue to celebrate dis feast, bikos na di day wey I take una komot from Egypt and una go dey celebrate am forever.
And wen una don enter di land wey di Oga una God go give una, just as E tok, una must do dis ofrin.
Una must celebrate dis feast for di rite time for di year.
Afta God don take una enter Kanaan, Hit, Amor, Hiv and Jebus pipol land; di place wey E promise una grand-grand papa sey E go give dem, land wey good well-well, den una go dey celebrate dis feast for di first mont for evry year.