Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 12:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 “Dis mont na di first mont for di year for una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 12:2
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di twelft year wen King Zazes dey rule, for di first mont wey bi Nisan, Haman kon sey make dem trow dice (na Purim dem dey koll am), so dat e go know di rite day and mont to do wetin e plan. E kon agri to do en plan for di thirtint day for di twelft mont, wey bi Adar.


For evening for di fourteent day for di first mont, make una chop bread wey nor get yist, until di twenty-first day evening for di same mont.


Make una tell Israel pipol sey, ‘For di tent day for dis mont, all di men go choose one yong sheep or goat for en family.


So Moses tell di pipol, “Make una remember today wey una komot from Egypt where una for bi slave. Dis na di day wey di Oga una God take una komot with en great pawa. So make nobody chop bread wey get yist.


For di mont wey dem dey koll Abib, una go celebrate di bread wey nor get yist feast and for seven days, una go dey chop bread wey nor get yist, just as I kommand una wen una komot from Egypt. Nobody go kom meet mi with empty hand.


“Una must always dey do di bread wey nor get yist feast. Una must chop bread wey nor get yist for seven days, just as I kommand and e go bi for Abib mont, bikos na for dat mont, una take komot from Egypt.


So dem start to use di Tabanako for di first day for di first mont for di sekond year.


God wey get pawa sey, “For di first day for di first mont, yu go sakrifice one melu wey dey okay kon klean di temple.


“For di fourteent day for di first mont, yu go start to celebrate di Passova Feast. For seven days, evribody go chop bread wey nor get yist.


For di first mont for di fourteent day for evening, una go celebrate di Passova to honor God.


“ ‘For di fourteent day for di first mont, una go dey do di Passova Feast to tank God.


Just to honor di Oga una God, make una dey celebrate di Passova evry year for Abib mont, bikos dat na di mont wey di Oga una God take karry una komot from Egypt for nite.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ