Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 12:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 “ ‘Na like dis una go take chop am: make una dress like who dey travel; wear una shoe kon hold una stik for hand. Make una rush chop am, bikos dis na Oga God Passova.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 12:11
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di king kommand di pipol, “Make una dey obey di Oga una God Passova, just as E dey dis kovenant book.”


Di blood go bi sign sey na una dey dat house, so dat wen I si di blood, I go waka pass and I nor go tosh una wen I dey ponish Egypt pipol.


Den Moses gada di eldas for Israel kon tell dem, “Make all di family kill one yong sheep or goat take celebrate di Passova.


Den una go ansa, ‘Na di Passova sakrifice for di Oga awa God, wen E kill Egypt pipol kon save wi and awa family.’ ” Den Israel pipol bow woship


So God tell Moses and Aaron, “Dis na di law wey follow di Passova. No strenja go chop from di Passova food.


Una nor go hurry komot dis time, or try to eskape, bikos di Oga wey bi una God, go lead and protet una for evry side.


“For di fourteent day for di first mont, yu go start to celebrate di Passova Feast. For seven days, evribody go chop bread wey nor get yist.


For di first mont for di fourteent day for evening, una go celebrate di Passova to honor God.


“ ‘For di fourteent day for di first mont, una go dey do di Passova Feast to tank God.


God tell Moses for Sinai Wildaness sey, “For di first mont for di sekond year afta dem don komot from Egypt:


“Make una ready to serve God and make una lite dey shine evritime.


“But di papa koll en savants kon tell dem, ‘Make una bring di best klot, ring and shoe and make una wear dem for my pikin.


Evry year, Jesus papa and mama dey go Jerusalem for Passova Feast.


E knee down for Jesus front dey kry and e kon dey wet Jesus leg with di tears from en eye. E klean Jesus leg with en hair kon kiss dem, den e pour di oil put.


Make una remove di old yist, den una go bi like fresh bread wey nor get yist and dat na wetin una bi. Bikos awa Passova lamb, na Christ wey dem don already sakrifice.


Make una wear shoe for leg wey go show sey, una dey ready to prish di Good News wey dey give pipol peace


Just to honor di Oga una God, make una dey celebrate di Passova evry year for Abib mont, bikos dat na di mont wey di Oga una God take karry una komot from Egypt for nite.


Israel pipol stay for Gilgal and dem celebrate di Passova for Jeriko field for evening for di fourteent day for di mont.


So, make una always dey ready for akshon. Make una shine una eye and put hope for di grace wey Jesus Christ go bring.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ