9 God kon tell Moses, “Fero nor go gri listin to yu, so dat I go fit do my plenty wonders for Egypt.”
Den God kon tell Moses, “Make yu go meet Fero, bikos I don make en and en savants heart strong, so dat I go fit show dem all dis my mirakles.
“But I know sey Egypt king nor go let una go, unless I force am.
God tell Moses, “Wen yu go back to Egypt, yu must do all dis mirakle and sign for Fero front, bikos I don put pawa for yor hand. But I go make Fero heart strong well-well and e nor go gri free my pipol.