Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 11:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 So Moses and Aaron do all dis wonders wey Fero si, but God make Fero heart strong, so dat e nor go let Israel pipol komot from Egypt.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 11:10
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God too get sense and en pawa dey mighty; nobody fit stand against am.


But God still make Fero heart strong and e nor gri free Israel pipol.


But God still make Fero heart strong and e nor gri free dem.


“But I know sey Egypt king nor go let una go, unless I force am.


God tell Moses, “Wen yu go back to Egypt, yu must do all dis mirakle and sign for Fero front, bikos I don put pawa for yor hand. But I go make Fero heart strong well-well and e nor go gri free my pipol.


But I go make Fero heart strong, even with all di signs and wonders wey I go do take warn am.


But God still make Fero heart strong and e nor gri listin to dem, just as Oga God sey e go bi.


Why Yu make us komot from yor plans and ways? Why Yu make us sturbon like dat, sotey wi turn from Yu? Make Yu kom back, bikos of doz wey dey serve Yu and bikos of di pipol wey bi yor own.


“God don blind dia eye and make dia heart strong like stone, so dat dem nor go si with dia eye and undastand with dia heart, so dem nor go fit kom meet mi, make I for heal dem.”


So, God dey sorry for who E won sorry for and dey ponish who E won ponish.


But God won show sey E dey vex, so E kon use en pawa against doz wey E won ponish.


But King Sihon for Heshbon nor gri, bikos na so God wont make e bi, so dat E go fit give di land to us today.


bikos God make di towns sturbon, so dat dem go attack Israel. God wont make Israel pipol kill dem anyhow, just as E don kommand Moses.


Wetin make una dey sturbon like Egypt pipol and dia king? Wen God ponish dem, dem nor sey make Israel pipol dey go?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ