28 So Fero tell Moses, “Make yu komot from where I dey and nor ever kom si mi again, bikos any day wey yu si my face again, yu go die!”
Asa vex well-well for di profet, so e kon put am for prison. Dat time, King Asa still vex opress some pipol.
As e dey tok, King Amazaya kon tell am, “Na who choose yu to advise di king? Make yu stop to profesai or dem go kill yu trowey!” Di profet stop kon sey, “I know sey God one distroy yu, bikos of dis tins wey yu do and yu nor gri listin to my advise.”
So make only di men go serve Oga God, bikos dat na wetin yu wont.” Den Fero drive Moses and Aaron komot for en front.
and Elieza (wey mean, “Na awa papa God help and save mi from Fero”).
Nor profesai for Bethel again, bikos na here di king for dey woship for di main temple.”
Na di same faith make Moses komot from Egypt and e nor fear di king vexnashon, bikos e get hope for God wey ordinary eye nor fit si.