Di kloud dey between Egypt pipol kamp and Israel pipol own. Di kloud make evriwhere dark for Egypt pipol, but give lite to Israel pipol, so dem nor fit near each oda till day break.
I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.
Na mi stop di rain to fall for una land three monts before una go harvest wetin una plant. Sometaims, I dey let rain fall for one town or field and di oda town go dry well-well bikos I nor allow rain fall for der.
Una papa kry to God make E help dem; den di aria between una papa and Egypt sojas, God make am dark kon kill all Egypt sojas inside di sea. Wetin E do for Egypt, una si am with una own eye. Una stay tey for di desert.