12 God tell Moses, “Make yu stresh yor hand face Egypt, so dat di lokust go kom kover evriwhere and dem go chop all di plants wey dey grow wey di ice-blok distroy remain.”
Di lokust kover di groun kon make am black, den chop all di plants and fruits wey dey for di tree wey di ice-blok distroy remain. No leaf remain for di tree and all di plants and grass, die finish for Egypt.
Den God tell Moses, “Tell Aaron sey, ‘Make yu stresh yor stik wey dey yor hand on-top di river, creek and pond dem for Egypt and dem go turn to blood; even di wota wey dey inside wood and stone kontaina.’ ”