11 So make only di men go serve Oga God, bikos dat na wetin yu wont.” Den Fero drive Moses and Aaron komot for en front.
Wiked pipol lie full my ear, but I dey obey yor kommands with all my heart.
Den Fero tell dem, “I swear with God sey, I nor go let una take una wimen and shidren follow body! E klear sey yu really get wiked plan!
So Fero tell Moses, “Make yu komot from where I dey and nor ever kom si mi again, bikos any day wey yu si my face again, yu go die!”
Den di king tell dem, “Moses and Aaron, na una dey make di pipol nor gri do dia work, abi? Make una go back go kontinue una work.