Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 1:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Egypt pipol make life taya Israel pipol with di kind hard work wey dem dey do with mortar, stones and all di work for di field.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 1:14
30 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So God tell Abram sey, “Make yu know naw sey yor shidren go bi strenjas for anoda man land. Dem go ponish and trit dem like slave for four hundred years.


as di yong men advise am. E sey, “My papa give una hard work, but I go make una work, hard pass as e bi before. My papa dey flog una with ordinary kane, but I go flog una with koboko!”


Make Israel pipol sey, “Na since wi dey small awa enemies don dey opress us.


Even pipol wey dey stay for animal house, dey si doves wey get feadas wey dem make with silva and gold wey dey shine.


“Si, I don take di load komot from una shoulder; I don free una from di heavy work wey una dey do.


So dem kon dey sofa and ponish Israel pipol. Na Israel pipol build Pitom and Rameses as di place wey Fero go dey keep tins put.


so dem kon dey ponish Israel pipol anyhow.


Di king wey dey rule Egypt kon tell Shifrah and Puah wey bi di Hibru nurse sey;


Afta sometaim, Egypt king kon die, but Israel pipol still dey kry, bikos dem dey sofa well-well. So dem kry well-well to God for heaven.


“Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, where una for bi slave.


Moses tell Israel pipol dis tins, but dem nor listin to am, bikos of dia sofa.


Just as pipol dey fear hongry lion and wiked bear, na so too poor pipol nor fit fight wiked ruler.


Oga God wey get pawa tell en pipol for Zion, “Make una nor fear Assyria pipol; even doh dem dey opress una as Egypt pipol bin do una.


Dem vex skata and kill pipol for oda kountries and dem nor dey taya. Dem vex rule oda kountries as dem like kon dey opress di pipol and e nor taya dem.


But I go gi-am to pipol wey dey opress una; doz wey dey make una liedan for street kon waka on-top una like sey una bi dirty.”


Di same tin don happen naw for Babilon, una don bi slave and dem nor pay anytin for una head. Pipol wey dey rule una dey make mout and dem dey always use my name make yeye.


Nor bi dis kind fasting I choose; but wetin I wont bi sey: ‘Make una remove sin from una body kon give betta judgement, den free pipol wey una dey opress.


Make una nor trit dem anyhow, but make una obey di Oga wey bi una God.


Una fit give dem to una sons and dem go serve una shidren-shidren forever. But make una nor trit any Israel pesin anyhow.


If dem hire am for evry year, en oga nor go trit am anyhow.


Yes! Una dey chop my pipol flesh, remove dia skin kon break dia bones. Una dey kut dem small-small like meat inside pot.


Naw, dem dey attack una town, so make una fetch enough wota! Make una defend una town well-well kon make betta stones with mud, den ripair di fence.


how awa grand-grand papa go Egypt where wi stay for many years. How Egypt pipol ponish us and awa grand-grand papa well-well.


E deceive and sofa awa pipol sotey e force dem to leave dia shidren make dem die.


I don si as my pipol dey sofa for Egypt and I don hear as dem dey kry, so I don kon save dem. Make yu kom, bikos I won send yu go Egypt back.’


Wen Egypt pipol dey opress and ponish us as dia slaves,


Make una remember sey di Oga wey bi una God, save and take una komot from Egypt, so dat una go bi en own pipol wey E go guide and na so una bi till today.


Naomi ansa, “Make una nor koll mi, ‘Naomi’, but make una koll mi ‘Mara’, bikos God wey get pawa don ponish mi well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ