Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 1:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 So dem kon dey sofa and ponish Israel pipol. Na Israel pipol build Pitom and Rameses as di place wey Fero go dey keep tins put.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 1:11
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So God tell Abram sey, “Make yu know naw sey yor shidren go bi strenjas for anoda man land. Dem go ponish and trit dem like slave for four hundred years.


So Josef make en papa and brodas setol down. E give dem one aria for Egypt, di best aria for di land; wey bi Rameses land, just as Fero tok.


di town wey dem keep en tins put; di town wey dem put en shariot and en horse dem and evry oda tin wey e won build for Jerusalem, Lebanon and oda place dem for en kingdom.


King Ben-Hadad gri with wetin King Asa tok, so e send en sojas go attack Israel towns. Dem win Ijon, Dan, Abel-Maim and all di towns where Naftali pipol dey keep tins put.


E build Tadmor for di wildaness and all di towns wey dem for dey keep tins wey E build for Hamat.


Dem waka from kountry to kountry, from one kingdom to anoda.


Make Israel pipol sey, “Na since wi dey small awa enemies don dey opress us.


Even doh enemies dey attack us since wi dey small kom rish naw, dem neva ever fit win us.


Even pipol wey dey stay for animal house, dey si doves wey get feadas wey dem make with silva and gold wey dey shine.


“Si, I don take di load komot from una shoulder; I don free una from di heavy work wey una dey do.


Egypt pipol make life taya Israel pipol with di kind hard work wey dem dey do with mortar, stones and all di work for di field.


Wen Moses don mature, e komot go visit en Hibru pipol. For der, e kon si how en pipol dey sofa, bikos of di work wey dem dey do. Den Moses si as one Egypt man dey beat one Hibru man wey bi en own pesin.


God kon tell am, “True-true, I don si how my pipol dey sofa for Egypt. I don hear dia kry for help and I know how dia sofa big rish.


So all di slave oga kon go tell Israel pipol, “Fero sey: ‘I nor go give una wetin dem take dey make block again.


Israel pipol wey dem take do oga ova dia own pipol kry go meet Fero kon sey, “Why yu dey sofa yor savants like dis?


And una go force dem make plenty block, just as dem dey do before. Na bikos dem nor get enough work naim make dem dey kom ask mi sey, ‘Make yu let us go sakrifice give awa God.’


Vexnashon bad and anga dey distroy tins, but who fit stand and bear jealousy?


how awa grand-grand papa go Egypt where wi stay for many years. How Egypt pipol ponish us and awa grand-grand papa well-well.


Wen Egypt pipol dey opress and ponish us as dia slaves,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ