Di messenjas take di kommand go all di aria for di kingdom. And di law wey dey inside sey for di thirtint day for Adar mont, dem must kill all Jew pipol; weda dem yong or old, both wimen and shidren kon take all dia propaty.
Di king give Jew pipol for di town, di pawa to gada and protet demsef, so dat dem nor go fit distroy and kill dem. Dem fit fight anybody wey won kon attack dem kon pak dia propaty.
But naw, make honga kill dia shidren and make dem die for war. Make di wimen luz dia husband and shidren; make diziz kill di men and make di yong men die for war.