Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Estha 9:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Dem kon know Mordekai for evriwhere, bikos en pawa for di palis, dey strong evriday.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Estha 9:4
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di fight between David and Saul family tey well-well. As David pipol dey strong evriday, Saul pipol kon dey weak more-more.


David kon dey strong evriday, bikos di Oga God dey with am.


David story spread go evriwhere and God kon make all di nashons dey fear am.


Naw, all di great and wonderful tins wey e do, with how e take promote Mordekai, dem rite dem for Media and Persia kings book.


E bi like tree wey dem plant near wota; wey dey bear fruit for di korrect time and en leaf nor dey dry. E dey prosper for anytin wey e do.


Yu make mi win doz wey dey akuiz mi. Yu make mi rule oda nashons and pipol wey I nor even know, dey serve mi.


Bikos God don plant dem for en house, dem go grow well.


(Naw, God don make Egypt pipol love Israel pipol. Even sef Moses kon bi one very big pesin for Egypt and Fero savants and Egypt pipol dey respet am.)


Raitious pipol ways bi like sun for morning wey dey shine well-well go rish evening.


En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.


And for dat time, I go ponish doz wey dey trit una anyhow. I go save di pipol wey dey weak and gada dem togeda. I go remove dia disgrace and dis go make di whole world dey respet dem!


So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.


God dey with Joshua and pipol kon know am for evriwhere.


“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ