31 and make dia shidren-shidren obey “Purim law” for di korrect time, just as dem dey follow di fasting and mourning laws. Na Mordekai and Kween Estha kommand dem like dis.
Profet Jeremaya sing one song for King Josaya and e don turn tradishon for doz wey dey sing for Israel and na both man and woman dey use di song wen dem dey mourn. Dem add di song join di oda mourning songs.
“Go gada all Jew pipol for Shushan, den make una fast and pray for mi. Make una nor chop or drink anytin for three days and nites. Mi and my savants go do di same tin. Afta di fasting, I go-go meet di king, even doh dat kind tin dey against di law. If na dat one go make mi die, den make I die.”