Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Estha 9:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 But Estha go meet di king and di king give orda make Haman use en own head karry di wiked plan wey e make. So dem kon hang Haman and en sons.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Estha 9:25
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

my Oga God, make Yu listin from heaven, den kon judge yor savants. Make Yu ponish di one wey do bad as e fit am kon free di one wey dey rite.


and since e don know naw sey Mordekai na Jew, e kon sey e go ponish am well-well. E kon dey plan to kill all di Jew wey dey di kingdom.


So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.


Bikos dem don sey make dem distroy, both mi and my pipol! If to sey dem just sell us as slaves, I nor for tell yu about am, but dem go soon kill all of us finish.


Den King Zazes ask Kween Estha, “Na who won kill una? Where di pesin dey?”


So make Yu nor let wiked pipol win mi, nor let dem susid with dia evil plan, if not, dem go dey proud.


Make Yu distroy my enemies with di evil and wiked tins wey dem plan for mi.


Make Yu let wiked pipol fall enter dia own trap and free mi from dia trobol.


and di trobol wey e plan for odas, dey fall for en own head. Na en own wahala dey kause trobol for am.


So, I go tank God, bikos E dey judge well; I go sing and praiz di Most High God.


So God go pay evil and wiked pipol back, E go distroy dem, bikos of dia sins. True-true, di Oga awa God go distroy dem.


So, anybody wey dig pit for pesin go fall inside my ensef and pesin wey roll stone to wound odas, na di stone go fall kill-am.


Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.


“For dat time, di peg wey bin dey der before, go fall for groun, den evritin wey hang on am, go skata.” God, wey dey lead heaven sojas, don tok.


“God Judgement dey kom for all di nashons! Just as una do to Israel, na so too dem go do una. All una evil works go fall for una own head.


Di pesin wey fall for dis stone go skata and di pesin wey dis stone go fall on-top, go grind to powder.


Wen David hear sey Nabal don die, e kon sey, “Make wi praiz God wey don fight for us, bikos of wetin Nabal do. God stop en savant to do bad and E don reward Nabal with di wiked wey e do.” Den David send pipol go meet Abigail sey make e bi en wife.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ