10 Dis na Haman wey Hammedata born, wey bi Jew pipol enemy, ten sons. But even as Jew pipol dey do all dis tins, dem nor ever tif or karry any propaty.
Di messenjas take di kommand go all di aria for di kingdom. And di law wey dey inside sey for di thirtint day for Adar mont, dem must kill all Jew pipol; weda dem yong or old, both wimen and shidren kon take all dia propaty.
Bikos dem don sey make dem distroy, both mi and my pipol! If to sey dem just sell us as slaves, I nor for tell yu about am, but dem go soon kill all of us finish.
Di king give Jew pipol for di town, di pawa to gada and protet demsef, so dat dem nor go fit distroy and kill dem. Dem fit fight anybody wey won kon attack dem kon pak dia propaty.
Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
Di king kon orda sey, “All di pipol wey lie for Daniel head, make dem katch dem, dia wifes and shidren kon trow dem for di lion pit.” Dem nor even rish groun before di lion dem bigin chop dem with dia bones.
Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about.