8 But di pipol must do wetin dem kommand and stamp with di king name. Yu fit rite anytin wey yu like go give Jew pipol kon stamp am with di royal stamp with my name.”
“So if my king go like am, make yu kommand sey make Vashti nor ever kom near di king again. Make yu let us rite am put for Persia and Media law, so dat dem nor go ever fit shange am. Den yu go give en place as kween to anoda betta woman.
So for di thirtint day for di first mont, Haman koll di king seketry kon sey make e rite dis kommand for all di language for di kingdom kon send am go meet all di rulers, govnors and ofisas for di kingdom. Dem rite am with King Zazes name kon stamp am with en ring.
“If di king like and kare about mi and if e dey good for yor eye, make yu kommand yor ofisas make dem nor do di tins wey Haman, Hammedata pikin, from Agag, rite about all di Jew pipol for di kingdom.